Good Friday: How Christians celebrate am across di world – BBC News Pidgin

BBC News, PidginWaka go wetin de inside

Wia dis foto come from, Getty Images

Good Friday na di Friday bifor Easter day. Evri year, Christians dey observe di remembrance of di crucifixion and resurrection of Jesus Christ.

Beginning from early days of Christianity, Christian believers dey observe Good Friday as a day of sorrow, day of repentance and fasting.

Dis year 2025, Good Friday fall on 18 April.

Although dis day na day of sorrow for Christians, di weekend of Good Friday na di most important weekend for di history of Christianity.

Believers of dis faith believe say na di day wey Jesus Christ die for dia sins, and dem bury am and im rise up on di third day as conqueror of sin and death.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Jesus die on di cross on Good Friday, di Bible tok, and e resurrect on Easter Sunday.

The Bible also record say dem beat Jesus publicly and force am to carry heavy wooden cross through di streets as di crowd dey publicly shame am.

According to di Bible, dem nail Jesus to di cross by di wrists and feet, wia e die. Now, Christians see im death as sacrifice to absorb di sins of humanity and allow im followers to get relationship wit God, im papa and access to heaven.

For Nigeria, several churches also enta di streets to demonstrate how Jesus bin suffer bifor im die.

Wia dis foto come from, Getty Images

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *